Friday 6 September 2013

Nawaoo Female Lawyer wey Dey Lead Gang Of Armed Rubber Arrested


Kasala burst when Naija police  catch a gang of 7 rubbers for Lagos. The leader of the gang Na one Lady called Chioma Ezekwesiri. The rubbers wey police catch wen they go rubb a man for Bolatito Hotel Ijaiye Area of Lagos. Police talk Somebody wey dey work for the hotel make distress call to the special Anti-Rubbery squad  (SARS)  that thief dey for their hotel.
Police spokesperson talk sey immediately dey receive the call dey move instantly to the hotel and surround the whole hotel. He said dey search everybody wey dey the hotel na during the process of searching dem discover two locally made guns and 12 life rands.

Chioma 32 years wey be the oga for the gang talk sey she be lawyer wey graduated from university of Lagos in 1999 and go to law school in 2000 where dey call am to bar. She even talk sey she get a non governmental organization (NGO) Youth Empowerment association.

Nawaoo weting go make a lawyer to dey do arm rubber?



Meanwhile police Don charge the 7 thief to court on the offence of conspiracy,  illegal possession of firearms and attempted rubbery.

2 comments:

  1. Dis one na real kasala.
    Chai! Ungreatfulnes no gud oooh.
    Igbo ppl money no dey eva do dem. Dey mst go extra miles.

    ReplyDelete
  2. Lol http://MegaStoon.Com/?share=20693

    ReplyDelete