Tuesday 3 September 2013

Indian Police Don Arrest One Naija Man with 190 grams of Cocaine wey worth 50 million Naira

Hin name na Abdul Raheem Kamalideen Kehinde, the police for India nab am after dey receive intelligent report sey Abdul Raheem won deliver concaine in a school wey dem dey call ITBP for new Dehli,


Oyinbo pipul talk sey everyday for the thief but one dey for hin owner, Na hin make police catch kehinde. Mama Pidgin gather sey dem don arrest Kehinde before in in 2011 for cheating but dey con latter release am on bail, in April 2011. Police talk after Kehinde komot for prison that year hin meet another nigeria who dey con both start to the trafick drug together.

the police talk sey the cocaine wey dem collect for am dey among the heviest wey dem don seize for many years. If the court for india find Kehinde guity dey fit send am go 10years for prison.

 Make hin just thank God sey no bi Dubai na to just cut his head.



No comments:

Post a Comment