Monday 2 September 2013

One Police Officer Don Kill Hin Oga Because Of Girlfriend

No bi small thingoo when one police corporal Bitrus Andrew allegedly kill hin Oga Olusoji Elegbede an assistant superintendent of police on saturday for Gashua town in Yobe state. Mama pidgin hear sey na woman cause the problem between Bitrus and hin ogaoo and all effort at settling the dispute between the two of them proof abortive. click  below to read how the whole tori take happen.
 Eye witness talk say Bitrus Andrew no  dey happy when hin oga collect hin girlfriend wey him don dey follow for more than eight years. Dem say Bitrus no dey happy when the DPO of the station wey dem dey work tell am make hin no drag the lady with Elegbede wey bi him oga and na sign of disrespect if hin dey drag lady with him, Na wetin vex Bitrus bi dat wey make am take law into him own hand, him carry riffle and shoot  Elegbede  five times for chest before Elegbede  com latter die for hospital.


People talk sey Bitrus wey him nickname bi Kwaba don dey with him girlfriend for more than eight years before hin oga wey dey just post to the area come.

But as the oga talk to the lady the lady con leave Bitrus and forget all the things wey Bitrus don do for the past eight years,  dem talk sey  Elegbede just get transfer to the command and the lady see am with car and other things and decided to abandon Bitrus

However the commisioner of police in yobe state talk sey Bitrus has been arrested and the dead bodi of Elegbede Olusoji has been deposited at the Gashua General hospital Mortuary.

2 comments: