Tuesday 24 September 2013

A 27years Old Man steal N6.8Million From ATM in Abuja

Police don catch a 27years old man for stealing 6.8 Million Naira from an ATM in Abuja. Although all the money was recovered complete but how was it possible for him to steal such an amount of money from ATM.

Na the question wey mama pidgin ask be dat. The police com narrate how the whole Tori take happen. Dem talk sey dey receive a call from the bank that some money don miss oo and somebody  don tamper with their ATM. This make dem to swing quickly to the place and on getting there dey discover sey the camera wey dey for the ATM no dey work again. Dem come try to enter the door wey Leed to the entrance of the machine but discover sey dem don lock am from inside. Dey were able to enter through another wey and fortunately for them dey see the man on the computer still trying to pack more money. Na hin dey gbap am...

The man com talk sey na for YouTube him learn how he go take break into an ATM oo that him buy all the instruments wey hin need like screw driver, hammer, and plyier which dem catch with am. Naija pipul too over smart!!!

No comments:

Post a Comment