Tuesday 3 September 2013

Which kine Parent Go abandon their 11years old Pikin for Hospital


The Papa and Mama of valentine Chukwu don abandon am for National Orthopedic hospital Igbobi Lagos.  Information from the hospital show sey the boy don dey for the hospital since December 27 2012 when him mama bring am for treatment. click to read the whole tori wey happen
The representative of the medical director for the hospital Mr. Adewumni Adetoba talk sey the boy bi 10yrs when him mama Mrs. Jessica Chukwu bring am for treatment at the hospital, Mr Adewumi further confirm sey the mama dey carry bele during that time wey she bring the boy, and further investigation wey the hospital conducted show sey the mama don born baby girl but she refuse to com take hin son. Mr Adewumi also talk sey the hospital try to locate the mama but they no get am and all the phone number wey she give them when she bring her pikin no dey go again.

The pikin talk sey hin mama dey live for Apapa why him dey stay with hin uncle Mr. Uche wey dey live for 16, Irorun Street, Alapere with his children, Junior, Chidimma and Emmanuel

the hospital talk sey dem don treat and discharge the boy oo and some good samaritan don pay all the money wey dey take treat am. Dey con dey call on the pikin papa and mama make dem com take their child o.

No comments:

Post a Comment