Sunday 1 September 2013

The ruling People's Democratic Party (PDP) Don Divide ooo

PDP new faction

Everybody know sey politics for Naija Na do or die affair for our politicians. Na hin make the party wey dey rule us go nak head for apata (Rock) and scatter. Some member of the party don go form their own faction of the party, Now the party don break into two faction. Mama pidgin think sey one na President Jonathan faction and the other one Na former vice president Atiku Abubakar faction. The new faction members include former vice president Atiku Abubakar & 7 governors which include Aliyu Wamakko (Sokoto); Babangida Aliyu (Niger); Rabiu Kwankwanso (Kano); Muritala Nyako (Adamawa); Abdulfatah Ahmed (Kwara); Sule Lamido (Jigawa) and Rotimi Amaechi (Rivers) .Also in the faction are an acting National Chairman, Kawu Baraje; a suspended National Secretary, Prince Olagunsoye Oyinlola and a former National Deputy National Chairman, Dr. Sam Jaja.

we no know wetin go happen next ooo. we just hope sey things go dey ok.

No comments:

Post a Comment