Sunday 1 September 2013

Mama Pidgin Sunday Uncommon Person For This Week Na Kanu Nwakwo (Papilo)

Kanu Ogbonge Naija Player
Kanu Nwakwo no need any introduction kanu na ogbonge footballer wey everybody for Naija and other places know wella. Today sunday uncommon person na papilow, I dey among many people wey believe sey, so far so good Kanu na the most successful footballer wey Naija don produce.  As usual for Mama pidgin i no go write plenti tori about Kanu. Make you sit don enjoy as you read some informate wey Mama pidgin get on Kanu. click  read more


1. Na for 1st of August 1976 him mama born am for Owerri Imo state Nigeria.


Kanu Nwakwo Papillo


2. Kanu Career started wen hin join Federation football club from where hin com move to Inwayawu Nationale between 1990 to 1993.

Kanu Dey Flenjo with Oyinbo Girls

3. Kanu first play for hin country at under 17  FIFA world championship in 1993.

kanu at Ajax

4. Kanu turning point began when Dutch Club Ajax FC sign am for £207,047 in 1993 Kanu palyed 54 matches for  the club and scored 25goals. Na for Ajax Kanu win him first champion league medal.


Kanu at Inter Millan

5.In 1996 Kanu moved from Ajax to Inter milan for $4.7 million Na this same year Kanu also played for Atlanta olympic where him pafuka brazil for semifal to qualify for final and eventaully to win the gold medal Kanu was also named african football of the year this same year

Kanu Diagnosed of Heart problem

6. in 1997 dokita  talk sey kanu don get problem for hin heart that can lead to serious gbege if they no do something about it, for almost two years papilo no play football has hin go for hin heart problem treatment.


Kanu signed for Arsenal
7.But  in 1999 Kanu com surprice everybody has him come back from his surgery to sign for Arsenal FC of England for for £4.6 million, Na the begining of a very eventful career for Kanu be this oo.


Kanu successful career Arsenal
8. Kanu Played for 5 years in Arsena hin appear for 119 games and scored 30 goals with a lot of gaol assist for arsenal Kanu also win alot of medal wey include, 2003 english Premier League and 2004 FA Cup.


Kanu wed Amarachi

9. In the year 2004 Kanu married is wife and mother of his children Amarachi Nwakwo in an elaborate wedding wey witness the presence of influencial people around the world .dem don Born 3 pikin together

Kanu and family
10. Kanu leave Arsenal and join Westbrom Albion of England He also played with Portsmouth before hin con finally retire.
Kanu with Portsmouth

11. Kanu  na ogbonge player wey dey always respond to Nigeria call whenever they call am make him com play for Naija. Him captain Naija and retired in 2010 after world cup. He get a heart foundation where him dey help children wey get hert problems

Kanu Heart Foundation

12.  Kanu Na the most successful and the most decorated Naija Player atleast for now this is year 2013

Kanu with Queen Elizabeth 

I No Tryiiiii?



The following na the award wey hin dom win for Hin carrier

1. Nigeria premier league with Iwanyawu Nationale 1992 - 1993 season


2. Ajax Amsterdam FC
     Eredivisie : 1993–94, 1994–95, 1995–96
     UEFA Champions League : 1994–95
     UEFA Super Cup : 1995
     Intercontinental Cup (1): 1995

3. Internazionale (Inter Milan)
    UEFA Cup : 1997–98

4. Arsenal
    Premier League : 2001–02, 2003–04
    FA Cup : 2001–02, 2002–03
    FA Community Shield : 1999
 
5. Portsmouth
    FA Cup : 2007–08

6. Nigeria
    FIFA U-17 World Cup: 1993
    Olympic Gold Medal: 1996
    2000 African Cup of Nations: Runners-up

7.    African Footballer of the Year: 1996, 1999
       BBC African Footballer of the Year: 1997, 1999

8. Brand Ambassador for pepsi UNICEF Peak milk etc.

No comments:

Post a Comment