Saturday 31 August 2013

Nawaoo A Mother Won Marry Hin Own Son




A 40 year old mama Betty Nbereko from Zimbabwe Don surprise everybody when she talk say she dey carry six month bele  (pregnancy) for her own son and she don dey set to marry him. Betty a widow of 12 years wey talk for court say the love affair between her and are piking started 3 years ago. She even talk sey na her money she take send the boy go school wen him papa die and nobody dey there wen she dey suffer to send the boy go school, na now when the boy Don finish and don dey make money pipul con dey talk make she no marry hin pikin. She talk sey they both love dem self and nothing fit stop her from marrying him. The 23years old son Farai Nbereko also talk sey him ready gidigba to continue eating the apple wey him papa leave behind 12years agooo and him mama love dey very strong for him heart to the extent sey him no fit marry another personooo.

Thursday 29 August 2013

Yawa Don Gasp Between Femi Fani Fakayode and Bianca Ojukwu

Some weeks ago Femi Fani Kayode talk sey Bianca Ojukwu dey among the lady wey him Don totori before she marry to General Ojukwu,This statement no com sound well for Bianca now she Don talk sey she has never meet Fani Kayode beforeooo and if Fani Kayode no apologize for the statement within seven days she go carry am go court make dem go settle am for court.

Wednesday 28 August 2013

Two Men Don Agree To Marry The Same Woman


Two men Don sign agreement for Kenya to marry thesame woman the men wey talk sey dey love the woman so much that dem no fit leave am for one another, the two men was caught by police when den dey fight over the woman, the police con ask the woman to take one out of the men for the dispute to be settled once and for all. But the Woman wey talk sey the love of the two men dey gidigba for her mindooo and she no won loose any of the two men dat she love the two of dem equally, na hin come make the two of them to sign an agreement say dem go dey share the woman and they no go cause wahala for the woman. But this Don generate wahala for Kenya and one of the Don even run away when the whole people Don turn against Wetin dem one do as people talk sey it is against the tradition of Kenya and against the constitution of their country.n sign agreement for Kenya to marry thesame woman the men wey talk sey dey love the woman so much that dem no fit leave am for one another, the two men was caught by police when den dey fight over the woman, the police con ask the woman to take one out of the men for the dispute to be settled once and for all. But the Woman wey talk sey the love of the two men dey gidigba for her mindooo and she no won loose any of the two men dat she love the two of dem equally, na hin come make the two of them to sign an agreement say dem go dey share the woman and they no go cause wahala for the woman. But this Don generate wahala for Kenya and one of the Don even run away when the whole people Don turn against Wetin dem one do as people talk sey it is against the tradition of Kenya and against the constitution of their country.

All the Student Wey Write University Entrance Exam for Liberia Failed

This one dey hard to believe but na the true talk. All the student wey write entrance exam to enter university for Liberia failed the exam. If the university authority shoud go with the result it mean sey nobody go enter university that year. According to the president of the country President Hellen Sirlef Johnson talk sey the education system for Liberia dey for mess. So no be for only Naija student dey fail Jamb is even worst for other country.

Monday 26 August 2013

You No go believe Am Ashewo Business (Prostitution) Don Become Legal For Switzerland Infact Dem Even Build Sex Box for Ashewos

Nothing we no go hear for this world, As from today 26 of August 2013 any Ashewo (prostitute) wey dey Switzerland must be registered to enjoy maximum protection and legal backing from Swiss government. Infact the governmemt Don construct sex boxes where customer fit go meet the ashewo any ashewo wey operate within this boxes go enjoy government protection, so no more one chance for road side again u fit just ennter any of the box and do as many round as u want provided u go fit pay. Meanwhile before any ashewo go fit enjoy this benefit hin must register with the government and show evidence of tax payment from the money received from the ashewo business. click bellow to see the sex boxes

Sunday 25 August 2013

mama pidgin congratulate Dillish For Wining 2013 BBA

Dillish
mama pidgin dey use this opportunity to congratulate Dillish of Namibia for wining BBA. mama pidgin hope sey our fans wey think sey na person wey show us how not to hold body or how to talk like parrot go win no too worry abeg make una no too vex.

Mama Pidgin Sunday Uncomon Person For this week Na King Sunny Ade (KSA)

Sunny Ade

If mama pidgin call King Sunny Ade (KSA) the most successful musician for Naija i know sey 80% of the people go agree with me. This sunday uncommon person Na King of juju music Sunny Ade. King sunny Ade na house hold name for old mama pidgin readers but for some of my young readers i know sey dey for don here dat name but dey may not know who be the real man wey dey bear the name Sunny Ade. As usual Mama pidgin no go write plenty tori about Sunny Ade. Click below to read and see more picture about KSA

Saturday 24 August 2013

Kai even for obodo Eyinbo people Dey Wake up from Death?

Sharon Jackson 50 years old woman wey wake up 13 days after dealth
The first person wey we hear sey him wake up from dealth  three days after hin die Na Jesus Of Nazareth . But for the past two month alot of things Don shele and still Dey shele for this ogbonge world. Last month for Naija one man claim say him wake up from mortuary after dokita don certify ham say hin don die. Last week also for this Naija we hear the tori of pastor Ajanaku wey wake up from dealth and shouted thank you Jesus before hin come finally say bye-bye to this world, though we still dey try to comfirm wether na lie or true about wetin happen to the pastor.  But another tori of people waking up from dealth don happen again this time no be for naija but for obodo eyinbo. The woman whom dem dey call Sharolyn Samson, whom dey talk say she die and dey burry ham on August 3 don wake up againooo. the family of the woman talk say dey see d woman 13 days after dey bury an m we no  know weting dey shele wai dem dey send people back from heaven ooo....

Friday 23 August 2013

Dis One No Be small Thingooo NDIC Talk say na Only 10 Bank Dey very Strong for Naija


NDIC bi Nigeria Deposit Insurance Corporation Na Dem dey pay money to people if  bank wey dem dey keep money with fail.you fit also talk say na dem dey insure naija bank, dem con talk sey out of the 20 Commercial bank wey dey naija na only 10 of dem dey srtong they sey the remaining 10 are satisfactory. we hope sey this satisfactory no mean sey na them no dey ok make naija people know wetin go happen to their money wey dey for the 10 satisfactory banks . Mama Pidgin even think sey NDIC go mention name of the 10 banks wey strong but they no mention any bank. wetin we know be sey if dem dey hide anything we go know one.

Thursday 22 August 2013

Things Dey Happen for This worldooo 70 Year Old Papa Insert Fork for hin John Tomos (penis) for hin to service Hin self

One 70 year old papa go put fork for hin banana just to derive sexual pleasure as the thing com enter he con tanda kidigba for inside in no won commot again see the picture of the fork for up if you won see how dokita con latter commot ham. click to see more and read the article but we dey won una say you go see some things wey go pump una eyesooo click below  and go to page 11 for the article to see how dokita take commot the fork abeg if you no prepare your eyes no clickoo

Monday 19 August 2013

Mama Pidgin Dey Wish Aisha Sesay Happy Married Life

Happy ogbonge marriage to Aisha Sesay of CNN

Na True or Na Lie JTF talk Sey Boko Haram Leader May for Don Die



We no Know person to con belief nowooo wether na JTF wey talk say Shekau for don Die  or or Shekau wey release video for internet sey hin dey gidigba sey dey no fit kill am.

Sunday 18 August 2013

Chai I Dey Always Gbadun My Main Man Comedian Elenu



See wetin hin said for twitter


Every Sunday Mama Pidgin go dey Nak You with special and very uncommon tory abt people you no very well which we go dey call MaMa Pidgin Sunday Uncommon Person. our today sunday uncommon Person Na BaBa 70


For Mama Pidgin Older fans the name Baba 70 go dey ring bell but for our youger fans wey no sabi who bi Baba 70, he no bi anyother person dan Fela Anikulapo Kuti. Mama Pidgin no go write plenty tori about Fela. I go just write some very uncommon tori about am. Make you sit back, go look for cold water soak gari inside enjoy as you read this lovely tori about Baba 70.
Click  after the cut to read more and see more picture of Fela kuti

Thank God The four Thailand people wey dem kidnap don dey free Now

The four Thailand citizen wey dem kidnap last week Don dey free now. Four Thai and two Naija people whom were kidnap last week by James bond militant for Naija Delta don dey free now, we thank God dey are now free men. I hear say these people dey work for a fishing company for Naija Delta. We no know whether money exchange hand or na bad market but we thank God they Don free dem. But wait sey fishermen too dey bring money ni?  I think say na foreign  oil worker kidnappers dey target... I beg no bi me talk am ooo.

When Sand mix with Garri Wetin we Go do Na hin make one House of Rep Member To get serious Beating from youth for hin Community


 A member of the house of Rep wey picture dey above was said to get the beating of him life by the youth of him community. Report reaching us even talk say na the third time wey Hon Ibrahim Babangida Maluta go get beating bi disooo. The Hon wey dey represent Malunfashi/Kafur constituency of Kastina state went for the marriage ceremony of the daughter of former speecker Aminu Masari, Immediately the see am dey begin insulting am. Dey talk say since hin Don become honorable member hin forget his people for village. Dey beat am so te him cloth tear before police con latter rescue am... 

Saturday 17 August 2013

Finally Osun People Don say Bye-Bye to Baba Obadare

Today Baba Obadare wey die some months ago was buried for hin state of Osun. Baba Obadare bi ogbonge evangelist wey dey popular for Naija and many other country, Na Baba wey found The world Soul Wining Evangelistic Ministry (WOSEM). Many people for Naija dey for Baba Obadare's burial Including the Gomina for Osun Ogbeni Abdylrauf Aregbesola. Bye-Bye Baba the people of Naija will always remember you

Naija Police Don Arrest A secondary School Leaver Who Claim Hin Bi Doctor after Hin Don Take Delivery of Over 90 Babies


Police Don arrest one Nwakwo Stephen wey no go medical school but con dey practice as a doctor for lagos. Nwakwo talk say na learn hin learn the workooo for Ondo state and since hin don dey practice he don deliver 90 babies from different customers. Nwakwo wey police gbap when a pregnant mama wey dey for him hosibita die. Police also gbap the owner of the hosibita wey Nwakwo dey do him fake doctor.

Friday 16 August 2013

Blessing Okagbare Don Win Second Medal for the World Atletics game wey Dey shele for Russia





Blessing Okagbare Don win again this time na bronze she carry for the 200m race wey shele for the ongoing IAAF world Athletic champion for obodo Russia. Blessing wey dey run like horse for track finish the race at exactly 22.32s to carry number three for the race.Blessing com finish the race at the same time with Murielle Ahoure of Cote d’Ivoire wey carry thenumber two position. Make we no forget say some week ago Okagbare carry Number two position for the lung jump event. Make you carry on blessing you be true pikin of your papa. Naija No Dey Carry Last.

Nawa For Oyinbo People Which One Bi Dis Again

Oyinbo Don invent something wey person fit use to dey carry hin Dog for bag to anywhere wey person won go. Wonder no go end for oyinbo landooo I no know if my people for Naija fit do dis kaihin thing by carrying there dog for back like pikin

Thursday 15 August 2013

Oga Femi Fani Kayode don apologize for him previous statement

Femi Fani Kayode Don apologize for him comment about all dose ladies wey him talk say him had affiars with. According to the information wey him paste for his Facebook wall Femi say him no mean to offend all those mama wey him mention there names him just dey try pass a message say hin no dey hate Ibo people. Him further went to say him done remove the name of dose women from his updated version of is initial essay.

Our people talk say word be like egg when hin reach ground hin go break, Fani Fakayode Don talk him talk Don hit ground and hin Don break.

Wednesday 14 August 2013

Super Eagles of Naija wire Bafana Bafana of South-Africa for deir Country by 2 oshara goals to 0




Our super eagles Don fly again for south-Africa after dem pafuka the Bafana-Bafana boys by two oshara goals to nothing for the on going Mandela cup wey de shele for South-Africa. Nsofor open the scoring when hin drible Nkule of South-Africa in the 49th minute. Na Nsofor also score the second goal when him receive a pass from Ahmed Musa for the 68th Minute. Our boys dey shine for South-Africa and dem dey tell anybody wey won know say Na naija still be Baba for Obodo Africa.

Ohuruguo Don win Gold Medal in Russia



Less than a week when one of una sister for Naija Blessing Okaghbire won silver medal in long jump for the atletics game wey they shele for Russia, Another Person wey i No sey Na Naija pikin wey con dey run for obodo Britain don win Gold medal for 400m race. Christine Ijeoma Ohuruogu wey dey run pass horse finish the race at exactly 49.41s to carry the oga position. I know sey na Naija blood wey dey flow for inside her body make am win. We no dey carry last for Naija... Naija we are too much

Today Na August 14 Make we Hear from Dose Wey Dey Celebrate Their Birthday Today


Today bi August 14... Mama Pidgin dey wish all our fans wey dey celebrate their birthday today HAPI Byi Dayoooo many hapi returns make we hear from una...

Femi Fani Kayode dey exchange word with him former colleague Obi Ezekwezyli

Our people talk say No permanent friends dey for inside naija politic dey also talk say no permanent ota also dey there. Na him make two former ministers dey Mis yarn dem self for twitter. Femi Fani kayode bi former minister for obodo plane (aviation) during Obasanjo's time while him second colleague na former minister for education Obiezekwezyli na during Obasanjo tenure dem both be ministers

Na wetin them they yarn them self for twitter be this below

Fani kayode wey no dey allow make them chance am for speech later come reply her with him own twitter


when friend com turn enemy abegi wetin we go do?

Tuesday 13 August 2013

Una All Welcome



Una all welcome to Naija first pidgin english blog. Na for here you go get the best gist about everythin wey dey happen for naija and for obodo eyinbo. you go hear the latest informate about wetin dey shele among your favourite celebrities, politicians, sport people, rich people, poor people, original people, fake people and many more wey go dey totori you welu-well for anywhere wey una dey for this world.