Sunday 25 August 2013

Mama Pidgin Sunday Uncomon Person For this week Na King Sunny Ade (KSA)

Sunny Ade

If mama pidgin call King Sunny Ade (KSA) the most successful musician for Naija i know sey 80% of the people go agree with me. This sunday uncommon person Na King of juju music Sunny Ade. King sunny Ade na house hold name for old mama pidgin readers but for some of my young readers i know sey dey for don here dat name but dey may not know who be the real man wey dey bear the name Sunny Ade. As usual Mama pidgin no go write plenty tori about Sunny Ade. Click below to read and see more picture about KSA

1. Na September 22 1946 dem born KSA. for Osogbo, Although KSA Na prince for him own town for Ondo state. People dey call am minister of entertainment

Sunny Adey performing on stage

2. Sunny Ade Musical career con begin when him go lagos for university education instead of going to school KSA decided to joing Moses Olaiya (Baba Salla) Musical group.
Young Sunny Ade

3. In 1966 Sunny Ade con form hin own musical group which he call Green spots. The success of the group introduce Sunny Ade to Everybody in 1977 Sunny Ade rename hin group to African Beat

KSA


4. For Dose who think say na only musicians  like Tuface, psqure wizkid or Dbanj be the only Naija musician wey dey move from one country to another to go sing for plenty audiences. All these musician still dey follow KSA for back-back. In the 1980s KSA tour  America and Europe to perform for both eyinbo and black wey dey there, that time hin tour that year was rank as the pop music event of the decade for America.
 Sunny Ade concert 


Sunny Ade Onyeka, Bakky W, Tiwa Salvage and....

Sunny Ade and Wizkid


5. Sunny Ade Na the first Naija Musician to be Nominated For Grammy award, dey don rank am as the best guitarist in Africa and the 69th best in the World. KSA na Baba for music hin don produce more than 100 album 
KSA

6. KSA don collaborate with great musicians like Steve wonder, Manu Dibango. KSA success tori open door for other Musicians like Yossouf Ndiour Selif Keita etc for obodo eyinbo
 Steve wonder perform with Sunny Ade




7. KSA don perform  for people like the former American president Bill Clinton when hin be president of united state of America.


8. In 1983 KSA con begin Hollywood careeroo. for that same year hin song was featured for an hollywood film titled Breathless staring Richard Gere . Hin soung was also use for another film titled One More Saturday Night. KSA self con tanda appear for one movie called O.C. and Stigs.



9. In 2009 Obafemi Awolowo University Ile Ife joing con give KSA a visiting Professor of music. KSA is also an inductee of the afropop hall of fame in brooklyn USA. 



No comments:

Post a Comment